Which Biblical characters are these:
1) "Na birthright I go chop?"
2) "Fine geh, we don meet before?"
"Yes nau- I be your 275th wife!"
"Ah! Ok..."
3) "Bros J, how? pesin go enter him mama belle again?"
4) "No be 3 people una throw inside the fire? E be like na 4 I dey see o!"
5) "Bros, how you wan take fetch the water? Wey ya bucket?"
6) "Make una jus throway me inside the water, everything go calm"
7) "E be like say dis man dey among dem!"
"Me? I no know de man o!"
8) "Na Peter dey knock o!"
Peter? You dey craze!"
9) "Your guy Lazarus dey sick!"
10) "Bros J, come fes..." He took him aside: "Wetin you dey yarn like dis nau? Abeg, stop dat nonsense!"
11) See dis boy! You think say I be bingo? You wan use stick fight me? See me see trouble!"
12) "Who be dat? He suppose die, as he no get pity!"
13) Son, na you be ram o!"
14) "Who be David? All dis small boys wey run from dem oga..."
15) Abeg, no vex! As I hear your voice, I come fear, as I no wear anything."
16) "Na who make we send?"
"Make una send me!"
17) "Bros P! Wish kain nonsense you dey do like dis nau? You don become hypocrite o..."
18) "Dis man- you get sense o! Oya- comman work for me as Prime Minister..."
19) "Make una calm down! I don kill lion, I don kill bear before- na giant remain..."
20) "Ha! Ok, give am the baby o! Abeg, no kill am!"
Let's test you knowledge of the Pidgin English Bible...
😇
Share this Scrolly Tale with your friends.
A Scrolly Tale is a new way to read Twitter threads with a more visually immersive experience.
Discover more beautiful Scrolly Tales like this.
