Part 2:
Which Biblical characters said these & to who?
1) Oya, bros- throw ya net for dis side...
2) Dem tell me say you get sense, I don confam am mysef!
3) I wan make you go marry runs geh!
4) You tink say dis bones fit live?
5) Whatever He tell una, make una jus do am!"
6) I know say na because of you God dey bless me
7) You neva suffer reach? Abeg jus curse God make you waka go!
8) As I jus throway the gold inside fire, na so dis calf jus commot!
9) If dem ask, na who I go say send me?"
10) Na your heart you suppose tear, no be ya cloth.
11) Mama, abeg- I no go leave you!
12) Chai! I no fit drink dis water o! Na de blood of de people wey go fetch am...
13) Madam, talk true: na dis amount una sell una land?
14) Oya- carry my stick, run go put am for de boy head!
15) Wetin consain me? Na me be him keeper?
16) You say you love me, you no fit tell me how you strong laidis. Wish kain yeye love be dat?
17) If to say una dey hear word, una for no sail comot & dis disaster for no happen!
18) Me sef I be prophet: na God tell me say make I carry you go my house go chop...
19) No be me call you, go lie down again.
20) "Wish kain nonsense be dis? I say make you curse dem, no bless you jus dey bless dem!
Mstcheeew!"
#PidginEnglishBible
Share this Scrolly Tale with your friends.
A Scrolly Tale is a new way to read Twitter threads with a more visually immersive experience.
Discover more beautiful Scrolly Tales like this.
