#DoubtlessThouArtMyFather (Isaiah 63:16) Profile picture
Official Twitter Account of HARUNA DANIELS, Architect, Kebbi State indigene; Bible Addict/Story Teller, CORE BATIST, Unapologetically in love with Nigeria. 🇳🇬

Sep 17, 2020, 5 tweets

Part 3:
Which Biblical characters said these to who?

1) Na wall be dis? Sometin wey if fox go climb untop, e go collapse!

2) You tink say my spirit no follow you when you go collect money & cloth from dat man?

3) If I be man of God, make fire fall from heaven roast all of una!

4) Na you we dey wait for abi na anoda pesin?

5) I sabi Jesus, I sabi Paul: who you be?

6) Bros Zaky, come down biko.
Na your house I go chop this evening...

7) If I jus fit touch him cloth...

8) Maybe una god dey sleep- make una shout well well, make una wake am!

9) See yasef?
You be king, you dey dance upandan like pesin wey don craze!

10) Na de man wey get dis ring & bangle gimme belle!

11) Dis boy, wetin you dey do here? Where you put de goats and sheep?

12) My son, e be like say your brother dey vex, he wan kill you join sef...

13) Ah! You again! You wan kee me as you kee dat man yesterday, abi?

14) Kabiyesi, e be like say I don get belle fa...

15) You no need come my house, abeg. Just talk am, my pikin go dey ok...

16) Why you dey yarn like all dis foolish women?

17) Lazarus die? We go die with am!

18) Abeg come kill me sharp sharp- make dem no say na woman kill me!

19) Abeg, no vex- if na only 5 righteous people dey dia nko...?

20) Jisos! Snake don bite am! E go soon die now...

Oya- let's go dia!
😇
#PidginEnglishBible

Share this Scrolly Tale with your friends.

A Scrolly Tale is a new way to read Twitter threads with a more visually immersive experience.
Discover more beautiful Scrolly Tales like this.

Keep scrolling