Summary of PMB's speech in pidgin.

A Thread 👇
My Pipu,

Afar?

1. Yawa bin too gas, naim make me come show face laidis. I don follow security ogas dem gist.

2. Make I cut warning give some of una wey dey misbehave unto the SARS protest wey shele. Normally, we don reason una mata na. SARS don cast normally.
3. To protest na una right, but e be like say ogogoro don dey whine some of una o! Una 5for5 dey table. Make una allow person reason una matter.
4. SARS don japa, unto say na part of the arrange for police, but e con be like say the speed wey dog take run enter house be like say e dey fear visitor o. Una fada well well!! If dem born una papa well, come protest again. Oponu! See small children o!!
5. Tins dey sup for area. Some of una don spoil, tiff, rape innocent people and una dey disguise say na protest. Una even free prisoners. Una come block airport.....some of una get mind sha! Weyrey!!
6. Oba of Lasgisi, sorry say dem use your palace do pool party.
7. Ehn! Na fake news go kill some of una sha cos una don dey ment. We plan na to lift 100m pipu comot for poverty. We don even target 100k pipu with 30k, like ads.
8. As per Sinzu Moni wey I be ehn, I arrange TraderMoni, FarmerMoni, N-Power, NAgric, NScience make the youths take chill. If money finish, I go call E-Money make im find una small thing.
9. Our Oyinbo pipu dey stagger sha! Una dey mad? Una get mind o! Dey listen to NTA and Radio Nigeria or come Ask Rock come collect ogbonge information, make ogun no kee una papa! Put your money where your flag dey, and dey mind your business!
10. My brave soldiers and gallant policemen, una try. I give una hand. For the ones wey kpai, Chilaxx with peace. We go try reason una salary. Our own na to make sure say Nigeria make sense. Laslas, we need more investor waya wayas to show face for this side. We go dey alright.
I don talk reach. Make I go reason small kunu for the night. Na God go epp una laslas.

Nagode!

@bbcpidgin

#PresidentialAddress #BuhariHasBeenABadBoy

• • •

Missing some Tweet in this thread? You can try to force a refresh
 

Keep Current with AwwGustine™

AwwGustine™ Profile picture

Stay in touch and get notified when new unrolls are available from this author!

Read all threads

This Thread may be Removed Anytime!

PDF

Twitter may remove this content at anytime! Save it as PDF for later use!

Try unrolling a thread yourself!

how to unroll video
  1. Follow @ThreadReaderApp to mention us!

  2. From a Twitter thread mention us with a keyword "unroll"
@threadreaderapp unroll

Practice here first or read more on our help page!

Did Thread Reader help you today?

Support us! We are indie developers!


This site is made by just two indie developers on a laptop doing marketing, support and development! Read more about the story.

Become a Premium Member ($3/month or $30/year) and get exclusive features!

Become Premium

Too expensive? Make a small donation by buying us coffee ($5) or help with server cost ($10)

Donate via Paypal Become our Patreon

Thank you for your support!

Follow Us on Twitter!