Aijay Profile picture
Wife/Mother/Banking/Military Enthusiast/Storyteller/Speaks Sarcasm/Ninja/I tweet in pidgin/Twitter DJ/I pledge to Nigeria my country to defend her unity.

Aug 27, 2019, 12 tweets

1. Dear Adèsina compliments of the weather sir! Oga mi! I hail! My hand dey for up! 🙌 Tuale baba! I want to be like you when I grow up sir! Ehmm sir I know say as a big boy, you no get time for little ones like me so anytime wey u fit, make you peruse this #Thread cos I observe

2. something since yesterday. Sir since your pictures begin circulate for Internet with some world leaders, some people don begin carve your statue as world leader! Sir abeg no see this thread as me trying to kill your dreams/aspirations, by the way I never reach! Even if them

3. press pause for your career for 10 years now press fast forward for my own 10 years, I still no go catch up with you. So make you no think am like that. Instead make you think am as small advise from person wey dey the main ghetto street wey get ability to see where them wan

4. package person 'local scam'. You go wonder how those tweets take be local scam. Make I explain am to you. E get some guys & babe's for this twitter wey their work na to find one unku/aunty wey don dey shine for outside, them go see you as the 'mark', draft proposal where dem

5. dem go package you to begin think say you big pass as you dey. Those guys once dem don identify you as mark, dem go begin recruit people wey go join them in hyping you. Na so everyday dem go dey tweet some kain things like how you single handedly averted iran/America war.

6. how you take catch Osama, finally dem go say if we give you chance as president you go now help us catch shekau & end herdsmen conflict. Unku, all this na wash-wash! Na better the more you look the less you see! By the time these guys set their proposal into motion, you sef

7. go begin believe say you rugged pass Obama & Bush joined together! Na their job to make person believe say e fit fly like bird! Understand one thing, all these their hype go lead to one thing; baba you must drop money! The money wey you don gather for your illustrious career

8. Na em these conmen don dey eye so! As you take picture with Trump, dem go tell you say Trump ready deploy the 75th rangers battalion to help you become president! As you take picture with Merkel dem go tell you say she ready reason with world bank to release billion of $ for

9. Campaign. Dem go tell you say Macron na your classmate so e go want make you be like am. Oga mi, shine your eyes ooo! The vultures are gathering! All na scam! Ask yourself some hard questions; if you go Sabongari for kano mention Adesina for 100 traders, how many go sabi

10. you? If you go Agwan rimi /ukwu or kawo market for Kaduna mention Adesina, how many go sabi you? What about sokoto, maiduguri etc? As a yoruba man what about Lagos? Them go ask you "which Adesina?" As una plenty with that name! No go allow these people chop you local ohh!

11. you dey doubt me? Ask Atiku! Dem scam that one enter inside server! Go ask your paddy Moghalu! That one too believe him hype for twitter sorte e say him twitter followers na proof say e fit win! What about Donald Duke? That one say make all of them return him money! Unku,

12. if you must run, no do am because of these scammers! Dem go chop your money! Instead enter street begin show ya face like the original starboy; Osinbanjo or else your name na 'election tribunal'!

I rest my case!

NB: you too much sir! I salute you sir!

Share this Scrolly Tale with your friends.

A Scrolly Tale is a new way to read Twitter threads with a more visually immersive experience.
Discover more beautiful Scrolly Tales like this.

Keep scrolling