Brethren shall we?!!
Baba dey shout," take me take me!"
Take who werey? My friend Chop your L and drink eismann beer
We reach freshers night, baba see him babe untop SUG FINSEC lap.
That's the night he picked up smoking.
Meanwhile we dey for back, dey look Facebook, dey see baba babe dey jubilate for her traditional wedding pictures.
Babe wen just cook sweet Egusi for us 2 days ago.
Town ko, province ni
Uncle ko, niece ni
Mama golden boy don show Owerri dey hotel dey wait make she stain him brand with rigorous ofu aka.
You wen dey EEE, go dey waka go OPT exam hall cos omo dem don use your eye see something
You go dey go manpower for morning see your babe, wen say she dey sleep around 9pm the precious night, dey zoom in on okada, from umuchima direction.
The water wen you wan fetch, go runaway your eye... Ayeeee ayeeeee
Worse still, na "bro CJ" wen dey always come town, na him dem dey marry..
na you go dey wonder, with tears in your eye, abi their village dey allow broda n sister marry?
Director of transport, go dey transport your hard earned babe to cloud 9.
Dem go dey shout greatest gbogbo for outside whole dem dey gbogbo your babe.
Aluta tears go dey flow comot your eye wen you find out.
Meanwhile a golden boy dey carry your babe enter sunic VIP section.
Try complain babe go look you like "Owunnabuike any problem?!"
L for Lekwam Jesus!
Na you go dey argue no! Sandra it's me! I will do better.
Cos omo you sef know say if dem substitute you, babe bench strong die.
Cos if dem say you Yaya sanogo out, you know say Messi, Ronaldo plenty dey beg to in.
You sef go dey hear her dey shout OMG! think say kai! Prayer warriors! Meanwhile
Hey God! Ugochi! This is your 137th aunty now, how many sisters your mama really get forgossakes
Imagine hand wen dem use carry drawing board from Hall B to 750 Cap, dem use that same hand break your heart.
Very young man but your BP go too rise.
New BF dey the same level, same lodge, infact baba dey stay the next room.
For night my guy go dey hear him ex dey shout "Chike you're a man!"
Come dey wonder, so I be goat when we been dey date?
You no go fit vess go.
When dem call your number "number 245" na you go still shout present!, den fill log book, enter and state your case.
You'll knock:"I want to see Nneka".
Friends: she's not around
You: I can hear her. She's there.
Friend: that's not her , that's her ghost, she's dead. Goodbye
You:
With different messages
"To the one I love"
"To my queen"
"To my sweetheart"
Nobody go tell you to hide your widows mite and chop your L with 2 futu, 1 meat, egusi and draw soup mixed.
Baba babe deny am flat "I don't know him oh"
Man ọ war give my guy some slaps and like 4 million frog jump.. Baba dey cry but we no know if na from heartbreak or the jump
Parliament
Glo Lodge
Ice box,
Executive,
Commissioners
Little Africa
Dominion City.
Or Koko mansion.
It's all over.
Chidi go tell madam say you'll be late for class you won't see seat oh.
She go say don't worry donatus my seat guy will handle it
You:
FYI I love my FUTO women like no tomorrow.. This was pure bants, don't tight it to your chest. Hope yall had a good laugh. That was the plan.
Let me go back to hibernation. This was fun. Good good memories.
Stevhoe out!