Those ogbonge big men of yesterday, na because say them dey near river na him make dem business sweet,attract oyinbo and come make them get plenty money reach way we read about them for school
UAC form that company 25 years before our Independence in 1960 to process for Nigeria and for outside market ,bring forex and create job,but which people kill am? Na @OfficialPDPNig .
Una remember that company
The company employ a lot of our mama and papa ,na who kill the company ? @OfficialPDPNig .
Who sell Delta Steel Company for Aladja and kill am way thousands of people no come get work for Warri? No be @OfficialPDPNig ?
But for 16yrs ,after @OfficialPDPNig don kill all our companies way employ our people by selling them to them friends through @atiku ,he come kill our ports patapata
@atiku kill Warri ports because him kolorbi every port operations in Nigeria to him company,INTEL .
Una see how person greedy and wicked?
Now he say him wan become
Abi him just look us for Delta State say we be uruwe?
As Second in Command to OBJ for 8yrs e sell everything way make us dey fit meet up as hardworking people.
My people we hear of freedom fighters b4 way work plenty for Warri,Sapele etc?
As @atiku kill all our jobs for Delta and Boyz no come get work,na so them begin play ludo with devil and militancy come become work till today.
Ship don land Udu River after how many years because of dredging.
The man mean well for us and don show am.
@atiku don say him go sell NNPC as him sell ALSCORN ,Delta Steel etc if him enter as our Presido
Make una shine una eyes as @atiku fit sell @NNPCgroup for ant money.
E no go reach am do.
Make una talk to people about @MBuhari vision today and vote @MBuhari come 23rd of February.
God Bless Nigeria!!
I hail una o!!!