Profile picture
Ehix @Ehix07
, 17 tweets, 4 min read Read on Twitter
POLITICAL-CIANS TRANSFER SEASON 3

THREAD
SARAKI: finally Sarakihino don finally dump e Mancity club(APC) & e quickly sign for Man-U(PDP). e talk say dem nor give am "juice appointment" for e former club,na e make am fashell dem. e new club (PDP) don quickly make am their captain & e na pilot now.We go soon know e skills
AHMED: Ahmed waka follow e oga dump e Mancity club(APC) & sign for Man-U(PDP).e 2 talk say e not like as dem take mention e name for one katakata wen happen for e club,say d thing touch am badly.But people wen get brain know say the man na anywhere in Oga Belle face,e go follow 2
ABDULLAHI: dis one na one of the Saraki kids. So long e Oga dump e club,dis Abdullahi too go follow am.not b today e start d follow follow and e not go still stop tomorrow.
Our prayer now b say make e not follow am go grave too.But we go hail am as e sabi e boy boy work well😭😭
TAMBUWAL: Tambuwal don follow dump e Mancity(APC) & sign 4 Man-U (PDP)
e talk say e not like as e former club take abandon e advice & request. But dt excuse nor sell at all because everyone know say e too get eye to play UCL(2019) next season.
We hear say e go wear no.9 4 e club
LADOJA: Nicolas Anelka LADOJA don dump e Man-U(PDP) again & e don sign for Liverpool(ADC).e talk say e not like as e former club dey run things,e b think say den don change but den still be goat wen go still shit black shit even if you carry am go Oyinbo
So e don move go new club
MAKARFI: D tory wen we dey hear say b like say Makarfi don dey get Belle pain,e complain say d way e club (PDP) Ogas dey run things now get as e b oo.Say make dem watch their back because dem wen build d club wen wahala dey not go open eyes see new comers put sand 4 dem garri o😭
PDP : PDP talk say na d club fans(NIGERIANS) go help dem select thier first 11 and go also choose who go be their top striker. Say na anybody d fans want go b their number 9😆😆.if you believe dis their tory,na e b say u too join those people wen use salt baff during ebola time😂
KWANKWASO: dis man wen den say e sabi d game well 4 e side don dey use style tel e club how 2 win(2019).e tell e club say if dey really wan win,say make dem pick their top striker from any player wen come from South America(K-States) say if dem pick another striker,e go hard oo😆
ATIKU: Nicolas Anelka ATIKU,tory wen our aproko ear dey hear say e club(PDP) don drop am go fielders team.den talk say e not go fit b thier top striker as e na injury player,though e club don deny dt tory.but d hand writing dey wall.if na true,dem nor do our E-PRESSIDENT well😭😭
SHEHU SANI: dis man don NEYMER all e SE and Saraki fans. After d guy don pass medical for e new club,d bro refuse to sign deal. E don come out talk say e not dey dump e club ooo say anybody wen not like am like dt,make e go treat himself.For now no more jackals & hyenas message😆
DOGARA: tory wen dey come talk say dis bros transfer matter don get K-leg even though e pass medical,but 2 get work permit from e home country(Bauchi) not easy for am oo
So 4 now,a bird wen dey hand better pass 10 wen dey bush ooo. So e transfer dey pending but we go soon know😆
OYEDEPO:Na dis guy but dey supervise e home team for e club (PDP) for Kwara. But as soon as e club sign Saraki, e quickly dump e club say e and Saraki not fit play for d same club because Saraki na Snake and ready to bite both e friends and enemies😭😭😭
WAMMAKO: dis bros just tell e club(APC) say make dem not worry say one of their top striker(Tambuwal) dump d club.e talk say d boy na up coming artist wen not no anything. E talk say waiting elders dey see for ground,a child not fit see am even if e climb iroko tree.
eyes on him
AKPABIO: Skysport dey report say dis guy wan dump Man-U(PDP) club & sign 4 Mancity(APC).den even say e don do medical,but na only personal terms come remain. Once personal terms agree on e fit sign.but dis info na still rumour because dis bros na top striker & 2 sign am go high
Till we come una way again,make God continue to butter una bread

END OF MISSIONARY JOURNEY ✌
Missing some Tweet in this thread?
You can try to force a refresh.

Like this thread? Get email updates or save it to PDF!

Subscribe to Ehix
Profile picture

Get real-time email alerts when new unrolls are available from this author!

This content may be removed anytime!

Twitter may remove this content at anytime, convert it as a PDF, save and print for later use!

Try unrolling a thread yourself!

how to unroll video

1) Follow Thread Reader App on Twitter so you can easily mention us!

2) Go to a Twitter thread (series of Tweets by the same owner) and mention us with a keyword "unroll" @threadreaderapp unroll

You can practice here first or read more on our help page!

Did Thread Reader help you today?

Support us! We are indie developers!


This site is made by just three indie developers on a laptop doing marketing, support and development! Read more about the story.

Become a Premium Member and get exclusive features!

Premium member ($3.00/month or $30.00/year)

Too expensive? Make a small donation by buying us coffee ($5) or help with server cost ($10)

Donate via Paypal Become our Patreon

Thank you for your support!