I know lots of lecturers way no go ever join strike way @ASUUNGR intend to call.
So,make @ASUUNGR no go fall dem sef hand like NBA fall hand for Onoghen matter with strike
@aishambuhari no go play love make e sweet Presido @MBuhari ,make him make mistake mention the 2 figure of CBN ATM pin.
Na beg me and well meaning Nigerians dey beg @ASUUNGR say this fight no be fight way dem go win as them wan just punish students.
Same way IPPIS go stop one lecturer way dey work for four different universities
I beg, one person don dey collect money from four or three different universities for years now e no reach?
@ASUUNGR i beg make una drink water on top the one una don enjoy since and no punish innocent students for una greed.
But wait o. How Lecturer go get three pikin and all the three dey school abroad?
Where e dey see money to pay $ £€ school fees?
How many handout e wan sell?