, 12 tweets, 6 min read
1. My people, Ministry of Niger Delta Affairs na His Excellency, President Umaru Musa Yar'adua create am for September 10 ,2008 to promote & coordinate policies for development, peace & security of our Niger Delta Region.
Na11 years d Ministry don dey gidigba if we calculate am.
2. From Bros Ufot Ekaette way start to head the Ministry to that our big Uncle ,Godsday Orubebe( I hope everybody remember brother Orubebe vs Jega 🤣 ) na so so billions we dey see them dey allocate to Ministry for Niger Delta with little or nothing to show like @NDDCOfficialNGR
3. One of the major project way people for Niger Delta believe say go sweet our belle na the East West Road and as money yanfu yanfu under the administration of @GEJonathan and Orubebe be Minister (two Niger Delta pikin),who side dem no fit complete am and many other projects.
4.Our brothers way because of dem wahala of sake of say dem take up arms against Nigeria join watin make Yardua form the Ministry for Niger Delta , join to chopulate from the Ministry as e come become means to settle them pocket .
Na money we hear,we no see completed projects 🤣
5. My people,e be like say better don dey Okra soup for us with the appointment of @SenatorAkpabio by @MBuhari to man Ministry for Niger Delta.
I dey knack my chest dey talk say better don land because of the "uncommon" nature of @SenatorAkpabio the way he take transform A/Ibom
6. We all know say @MBuhari like us well well for Niger Delta with all him policies towards Ogoni clean up, Ajaokuta - Itakpe - Warri Rail completion, Dredging of Excravos, Concession of Warri Port to Sifax and other ogbonge things way e dey do to bring economic revival for us.
7. But with the appointment of @SenatorAkpabio e show say, President Mohammadu Eyimofe Ogheneochuko Buhari sit down and think am well say who go fit help him actualize the @TheNextLevelNG infrastructural vision for Niger Delta people ?
@SenatorAkpabio, no fall @MBuhari hand o.
8. We for the region know say as you, @SenatorAkpabio use major contractors work for A/Ibom day & night, remove Okon & Ekaette dem from house boys & house girls all over Nigeria & make dem regain confidence ,na all we expect to see say you replicate as Minister For Niger Delta o.
9. @MBuhari don kuku make the work easy for you, @SenatorAkpabio ,the uncommon ogbonge pikin from Niger Delta, with better allocation to ya Ministry na to roll your sleeve and hit the ground running make our region no forget you like your people for A/Ibom no go ever forget you.
10. Finally, na God I take beg @A_Oshiomhole ,@RotimiAmaechi @OvieOmoAgege James Manager & all the Niger Delta Governors to give @SenatorAkpabio all the support way him need so as Niger Delta go enjoy better uncommon developmental infrastructural projects this very crucial time
11. Struggles, permutations & assumptions of this person or that person go become leader or strong pass me for the region don draw us back for Niger Delta too much.
Them no dey carry power go heaven or bury person with money inside coffin .
Make una work together for Our People.
12.
God Bless Niger Delta Region.
God Bless Nigeria.
Missing some Tweet in this thread?
You can try to force a refresh.

Like this thread? Get email updates or save it to PDF!

Subscribe to eguando tone jeff
Profile picture

Get real-time email alerts when new unrolls are available from this author!

This content may be removed anytime!

Twitter may remove this content at anytime, convert it as a PDF, save and print for later use!

Try unrolling a thread yourself!

how to unroll video

1) Follow Thread Reader App on Twitter so you can easily mention us!

2) Go to a Twitter thread (series of Tweets by the same owner) and mention us with a keyword "unroll" @threadreaderapp unroll

You can practice here first or read more on our help page!

Follow Us on Twitter!

Did Thread Reader help you today?

Support us! We are indie developers!


This site is made by just three indie developers on a laptop doing marketing, support and development! Read more about the story.

Become a Premium Member ($3.00/month or $30.00/year) and get exclusive features!

Become Premium

Too expensive? Make a small donation by buying us coffee ($5) or help with server cost ($10)

Donate via Paypal Become our Patreon

Thank you for your support!