, 16 tweets, 10 min read Read on Twitter
Sons and Daughters of Niger Delta Killed Our Region.

#Thread 👇

My good people of Niger Delta,our problem no be Hausa ,North, @MBuhari ,Fulani, @ProfOsinbajo or Yoruba,but our own people .
Our people bad so tay dem dey fool us with wayo to make us believe say na Hausa or Yoruba
2. Even dem go do wuruwuru and magomago with newspaper house like @vanguardngrnews way be say na our own ogbonge papa,Amuka Pemu na him be publisher to manipulate our mind.
I beg, my people better pikin dey take left hand point hin papa house?
Na watin our people for Niger Delta
3. Dey do be that.
How person way dem give money to buy goat way dem wan take bury him papa go carry the money go buy birthday gift for him girlfriend?
How one person go chop full community money & expect say him life go better?
Na watin our people do dey do to wicked us be that
4. See, as son from the region and ogbonge Itsekiri man,I go start with watin my own brother do.
I guess we all sabi Tuoyo Omastuli way be Director of Project for @NDDCOfficialNGR ?
Na about 1.8bn of assets @officialEFCC collect from am all for Lagos o.

m.guardian.ng/news/court-ord…
5. @NDDCOfficialNGR na intervention agency way government set up to develop the region,but our brother way head project for the agency see am as opportunity to make money for himself and use our Niger Delta development money to buy houses for Lagos and develop Lagos house market.
6. Our big Ijaw bros from Sagbama in Bayelsa State,Uncle Boroh, way dem say make him come help arrange things make e better well for Amnesty Program office see am as opportunity to help himself too.
@officialEFCC don hold am for fraud of N975m.
thecable.ng/efcc-arraigns-…
7. How many of una know @NDDCOfficialNGR HQ office for Port Harcourt?
Una know say na 2000 dem form the agency?
How a whole intervention agency no fit complete him own headquarters and dey pay N300m rent yearly?
Such agency,any better fit come out of am?
punchng.com/nddc-abandons-…
8. The construction of @NDDCOfficialNGR 12 story Headquarters in PH don dey on since 21yrs same time dem born my brother girl pikin, now she don graduate from University ,yet e never complete,but e sweet dem to pay N300m rent .
Maybe na one oga get d house
images.app.goo.gl/Fdf219oCk17ojn…
9. During an audit in 2015, despite N423bn way dem don spend for project by Niger Delta Ministry ,dem say na 12% project execution dem fit achieve .
My people if we look well,that 12% sef fit no reach ,maybe na 7%.
Our people too wicked to us o,I fear.

premiumtimesng.com/news/headlines…
10. How many of una remember our Ondo IJAW brother, Kingsley Kuku our bros way be the ogbonge special assistant on Niger Delta on Amnesty under Presido @GEJonathan? Na N6.2bn matter him and @officialEFCC dey wear on trouser leg since & bros run go abroad.

thenationonlineng.net/alleged-n6-2bn…
11. My people,una don see am say every opportunity way our people get na to steal money for development of our region and use the money go buy house for Lagos,Abuja or abroad ,while our region remain backward and be go just dey suffer ,while them blame Fulani & North for our woes
12. Government bring 13% derivation, created @NDDCOfficialNGR Niger Delta Ministry & Amnesty Office ,that is about four intervent agencies to help develop our region.
Add that to Constituency projects from @nassnigeria our region for don be Dubai if not for greed of our leaders.
13. My people from Niger Delta,na time for us to #WakeUpNigerDelta shine our eyes and look inward.
Make we hold our governors, people way head these four agencies and our legislature's way dey collect constituency project accountable for the sake of our region & children unborn.
14. Enough of this wayo and magomago jibiti of washing our brain with gutter water say our problem na @MBuhari, Fulani or North .
The Community projects way @Shell and @Chevron dey wan assist do,community leaders sef dey kolobi am & even fight them to put the money for pocket too
15. I no know if dem use juju curse dem?!

The solution to our problem and only way to see development,make we #ShineEyeNigerDelta and #WakeUpNigerDelta to expose all dem wicked people .
We get right to #OpenNigerDeltaOleYansh for social media with Facts.
16. My People of Niger Delta ,I hail o.
God Bless Our Good People.
God Bless Our Region.
God Bless Nigeria.

cc:
@TheresaTekenah
@Hejeoma
@TemisanIkomi
@ALIBABAGCFR
@fkeyamo
@OvieOmoAgege
@SenatorAkpabio
Missing some Tweet in this thread?
You can try to force a refresh.

Like this thread? Get email updates or save it to PDF!

Subscribe to eguando tone jeff
Profile picture

Get real-time email alerts when new unrolls are available from this author!

This content may be removed anytime!

Twitter may remove this content at anytime, convert it as a PDF, save and print for later use!

Try unrolling a thread yourself!

how to unroll video

1) Follow Thread Reader App on Twitter so you can easily mention us!

2) Go to a Twitter thread (series of Tweets by the same owner) and mention us with a keyword "unroll" @threadreaderapp unroll

You can practice here first or read more on our help page!

Follow Us on Twitter!

Did Thread Reader help you today?

Support us! We are indie developers!


This site is made by just three indie developers on a laptop doing marketing, support and development! Read more about the story.

Become a Premium Member ($3.00/month or $30.00/year) and get exclusive features!

Become Premium

Too expensive? Make a small donation by buying us coffee ($5) or help with server cost ($10)

Donate via Paypal Become our Patreon

Thank you for your support!