Profile picture
bucky @noir2u
, 10 tweets, 3 min read Read on Twitter
Soooo, let's talk CCT (conditional cash transfer) tingz. Na long thread ooo!

Naija Govt negotiates refund of $322.5 Million of Abacha loot from the Swiss.

Naija: Awa moni dey una hand. Return am kwik.

Swiz: You pippul no trustworthy kobo. We return $700 Mill btwn 2005 - 2014
Na OBJ and GEJ dey power den. Dem talk say di moni na for development projects but dem just tief am lai dat. Awa eye don clear. Una get CCT? Dis moni, na only di poor go get am.

Naija: We dey do CCT for 2 years. We don cova 19 states. We go use Abacha moni to cova all 36 states.
Swiz: How long dis una CCT go last?

Naija: We go use di Abacha moni to fund di program for 6 years.

Swis: How much una dey giv di poor pippuls?

Naija: We dey giv dem N5K (Five Tasand). But so moni go big small for hand, na N10K we dey giv dem evri 2 months.
Swiz: Das gud. How long wee di poor pippul get dis moni?

Naija: Once dem qualify, dem go get di moni for 3 years (tiri years). In dat 3 yrs, we dey train dem to save, to do bizness, to improve demselves. So dat at end of di 3 years, dem go get small ting to do.
Swiz: Na true? Dis wan good oo! Wot abat families wit women wey get belle? Get small pikin? Or get small pikin wey dey go skool? Your maternal and small pikin deaths dey too high. Den plenty pikin no dey go skool. How una see fight dat big problem?
Naija: Dose ones dey get double double. We dey giv dem extra N5K on top efri month. So na N10K dem go get a month (or N20K efri 2 months).
Naija: Buuuutttu, to get dat moni, dem must dey go antinatal for hospita, dey get all di injections and vacines for dem and dere small pikins. Den dere pikin wey fit go skool must dey attend skool, oderwise top-up moni go stop.
Swiz: Ehen, so how many pippuls go get dis moni for 3 years?

Naija: We caculate say 640,000 poor pippuls go benefit.

Swiz: Dis na great ting oooo. Buutttuu, make una no vex, how we no say una no go just tief all dis moni?

Naija: Na World Bank dey help us administer di program.
Swiz: Weh done. Weh done. Oya, send us dat ya akant numba. We go do transfer of $300 Million balance wey dey awa hand.

Naija: Moni must return to us wit interest oooo. So no bi $300Million anymore. E don increase to $322.5Million.
Swiz: Choi! Una don sharp like so?? Okay sha, na tru tingz.

Naija: We don get alert! Tank you!

#CCT
@ProfOsinbajo
@akandeoj
Missing some Tweet in this thread?
You can try to force a refresh.

Like this thread? Get email updates or save it to PDF!

Subscribe to bucky
Profile picture

Get real-time email alerts when new unrolls are available from this author!

This content may be removed anytime!

Twitter may remove this content at anytime, convert it as a PDF, save and print for later use!

Try unrolling a thread yourself!

how to unroll video

1) Follow Thread Reader App on Twitter so you can easily mention us!

2) Go to a Twitter thread (series of Tweets by the same owner) and mention us with a keyword "unroll" @threadreaderapp unroll

You can practice here first or read more on our help page!

Did Thread Reader help you today?

Support us! We are indie developers!


This site is made by just three indie developers on a laptop doing marketing, support and development! Read more about the story.

Become a Premium Member and get exclusive features!

Premium member ($3.00/month or $30.00/year)

Too expensive? Make a small donation by buying us coffee ($5) or help with server cost ($10)

Donate via Paypal Become our Patreon

Thank you for your support!